Saturday, February 28, 2009

Naija Man, Mschew!

Egba mi oh my people
come see ohh
E yan say em luf me
me no wan gree
E tell me say e go die without me
me still no wan gree
I tell am say I no be easy chic
Em no wan gree
I tell am say e no fit handle me
Em no wan gree
E tell me say anything wey I want
make I come tell am
I look am up down, laff small
left me oh, I tell am
E beg, E cry
Me no wan gree
E spend money E beg
Me no wan gree

Oya na,
give me ya bank account number
E no gree
Giff me control power for ya company
E no wan gree
E no dey gree call me again
E don too hard for am to send text
E no wan show for my domot again
See naija man
E luff me die
But em luff em money pass

From the perspective of a Nigerian Woman.

4 comments:

  1. LOL.. Yeah right.. Una don come again o!!
    Yabbing my Naija brethren.. Una suppose go try am with Richard Branson then.. Let's see if you'll own Virgin.. Pshewww.. :) ;)

    ReplyDelete
  2. I bet Richards wife owns at least a quater of his $$$. HA!

    ReplyDelete
  3. hahaha! What?! You wanna ruin the guy? Tell me, what kinda love will let the guy give you ALL his money?

    Love ko, love ni. lol!

    ReplyDelete